Tag: Apian way

Anoda Banga !!!!! As Apian Way Nack Anoda Hit !!

Una for don dey hear Rukewe and Julie say dem dey date. But di mata don tear leg open o! Apian way; di number one and the only Theatre wey dey use pidgin from top to bottom steady for six years don ready to push Rukewe and Julie comot outside to take mark di ground opening for West Africa Naija Symposium. Di author, Ogini bernard wey be theatre graage plus overgraduate citizen and di owner of the Production House yan say, naim contribushun to di history of di language base on im research and im contribushun for di mata wey all Pidgin expert for di world go meet yan ontop di future of di language and how di language don grow. E go shele for June 27&28 for Wole Soyinka Theatre University of Ibadan, 7pm, wit ticket wey be 1k and 5H for student. Pidgin na we own mek we use am.